Today's special edition weh we dey present dey dedicated to those our movie persona weh nobody dey hail as we suppose hail. Na them be the people weh be say them be original Oga for being mercenaries or as we dey call am for our side here; "hire killers". These na the men weh be say if u need make person do dirty job or job weh be say normal person weh no be craze person no go gree do, na them u go call. Na these guys dey always do things weh them and the law no dey see eye to eye. Make I quickly tell you, no be all of them be bad person O, and no be all of them good join. Toh, who be these guys weh I dey yarn about so? Abeg no commot ur eyes from this page O, just follow this our stori go down;
- Erik Killmonger: this one na from our own place. Na African guy, from Wakanda, and you know say we black men, when we wn do bad thing, we dey do am in very wicked fashion. This guy even before him return come him hometown, una see wetyn the guy do him partner na? Hear the guy name sef, the guy dn sabi kill people and him like am so tey them kukuma nickname the guy " Killmonger". That one no be small feat O. Before I go forget to add, u remember say the guy even with all him badness, him become King O, even Ayo no even fit oppose am as the guy dn display say him fit kill anybody weh do anyhow fa! But as u dn hear small about him story so, u think say the guy suppose be the king of all these other baddoo guys? Make we see sha!
- Dead Shot: this one na the kind of guy weh them dey call the very good bad guy. People no even know whether to like the guy or to hate am, but wetyn dey always sweet us pass for this him stori na say the guy sabi wetyn him dey do well well. You know say the guy sabi shoot gun so tey them name am dead shot. The guy no dey gree miss when him shoot fa. If u want make him kill person for u, him go deliver O, even if the person dey for okene, and himself dey for wuse zone 3. You know wetyn be the guy problem? Na say him get family, one small pikin weh dey always look like say dey hold the guy back from achieving him true potential. But wetyn we fit do?
- Deadpool: this one no be normal human being O. The guy no get fear one, the guy no get respect, and the guy sabi fight and shoot like tomorrow no dey. I never even tell u the one weh make sense pass, the guy dey heal O. No matter how u take shoot am , the guy dey heal himself O, so na like say na human wrecking machine the guy be. the guy himself na jazz. U know say this same guy, them dn bomb am before, na so him just go hide for hole until him body regenerate fa. This one na Oga killing machine!
- Hitman: this one too na baba for gun matter. The guy sabi dey shoot dey fight. The guy na corporate killer. Him dey wear suit, red tie and that him omolo head. Na so the guy go just enter target area or the kill area start dey unleash mayhem. But one thing weh dey with this guy na say him na original Hitman, him no too like barazana. Him own na to enter quietly, kill, go, cash money, and await the next one. But the guy efficient die sha!
- John Wick: this one na another corporate hired killer O. The way weh this guy dey even follow operate na on another level. Them get system. But forget the system, this mad man weh u dey see so, him dn retire, but the guy still sabi fight die. The guy fit dey run, dey summersault and dey shoot all at the same time and him go still dey hit headshots, the guy badt like that. The guy no too dey fear gun because even the guy suit get kevlar woven into the slits. E just be like say the guy dey wear bulletproof suit. The guy also dey efficient. Him highlight na say him enter crime boss den, clean the whole place out. I cut cap for that one sha.
- Death Stroke: Oga Slade Wilson. This one na all-rounder. Him sabi shoot, him sabi fight, him sabi swords play. In fact the guy na ninja. This na the only guy weh be say e be like say him dn fight both arrow and batman to standstill fa. This man here dn even get the mind to challenge Ra'z Al Ghoul. I like this one, because the guy no be I too know( ITK), the guy dey carry people join body. Na why him bad come dangerous be that, him strong, come dey very charismatic. Him go just make u join am for nothing. Well, the guy dn put a whole city under siege. Him dn beat Arrow to near death, and him dn lead the suicide squad once upon a time.
- The Punisher: you know why I like this guy so much? The guy na good guy, and him dey do bad bad things without remorse. Once the guy decide say u be bad guy, him go clear ur doubt and him no go look ur face. The guy no get any special powers fa, him just be regular soldier. But once him vex, guy na killing things be that o. Even police dey fear the guy. Just see the logo for him shirt, you no go fear?
- Jango Fett: for a universe abi na galaxy, as big as the star wars universe, them dey fear Jango Fett O. The mere fact say the guy na mandalorian na wahala, with that their jet pack, them be original unpredictable bad Ass!! But last last, regardless of the fact say the guy get Big reputation like that , we no really come see wetyn d guy get to offer, apart from the fact say the guy break into Republic strong holds, evade the jedi for a very long time. The guy no dey too efficient, but him get reputation like mad!!.
Bane: this one na all about strength. The guy dey ball. The guy dey lift, dey throw, dey punch. The guy beat devil comot from batman body come imprison the guy. The guy beat fire comot from batman body, the guy come mellow. Why me I no too personally like the guy na say the guy dey dope, him dey use enhancements. If u cut his supply, him go just become normal. Again o, contrary to popular opinion, the guy na master planner. He brought Gotham to a standstill. But does he deserve the one true ring to rule them all? Make una tell me, my ear dey ground gidigba!
No comments:
Post a Comment